06 September 2017

Seun Kuti(Musician) Calls Out Buhari-led Administration


The outspoken son of late Afrobeat Legend Fela, Seun Kuti, is apparently not happy with the way the Buhari-led administration is running the country.
Suen took to Twitter to express his thoughts and call out the government on some national issues.
In a series of tweets, he wrote;
“So dey want us to think stupid, everybody celebrating, deyve bn celebrating all dis days, but who is celebrating d slavery days
Naija Youths ask again, Wetin b dis present Naija govt policy on Education?
Every ruler dey talk about peace, but none of dem dey talk about Justice, no job & food 4 d poor, uni don close for wks, Youths r idle
Wetin happen to equal right & justice, why most Naija rich pikin dey go uni 4 oyibo land & dem go come close our own uni for our motherland
Wetin happen to equal right & justice, why some people go sick and go foreign land for treatment, wen poor pesin dey die 4 Naija of malaria
Wetin happen to equal right & justice, politricians go dey rich pass wen dem enter power & court go still find dem not guilty of corruption
Wetin happen to equal right&justice, poor pesin go go jail 4 stealing N100pepper 4 Mkt,politricians go waka free 4 stealing billions in govt
Wetin hapen 2 equal right & justice,Peadophile go rape poor pesin pikin,police go settle out of court like notin happen,rich pesin fit gree?
Wen we no sabi our govt policies on many things, how we go sabi our right ? My people ask for yur govt policies
Wen we no sabi our govt policies on many things, how we go sabi our right ? My people ask for yur govt policies
We d people need to start to dey ask our politricians for figures, e.g., “if u say u wan build road, oga Wer u go get d money”?
We Naija people need 2 stop 2 dey accept injustice from govt, Na bcus of us Govt dey, no b we dey bcus of Govt
I hear say Govt Na our papa & we b d pikin, if Govt b our papa, Se Govt suppose to dey let us(im pikin) suffer like dis?
That’s why I open my mouth I sing ‘For Dem Eye’ “we no important for dem eye”, bcus if we important, uni no fit close mke Govt no fit yarn
If we important ‘for dem eye’ poverty no fit dey contri like dis mke dem never find solution, while dem dey live rich in der big hses&yatch
I ask again after all dis yarn, “Se our Naija Rulers dem like us or dem like demsefs?”

No comments:

Post a Comment